We sure sey una sabi di right to freedom of movement, di right to dignity, di right to fair hearing and di oda ones wey dem call the fundamental human rights which dem put for Chapter 4 of the 1999 Constitution. Na all dis rights dey enforceable in Court and as we don talk am for we posts, you fit approach the High Court of a State, as e dey under Section 46 of the Constitution, and di Federal High Court, as dem talk am for the case of FUTMINNA v Olutayo (wey di Court relied on the Fundamental Rights (Enforcement Procedure) Rules)
But di mata neva finish.. di right wey we get as pesin no end for just civil and political rights. We get di right to education, good health care, access to gainful employment and adequate means of livelihood, housing, good standard of living and many more. All dis rights wey we mention dey under socio-economic rights. The problem no be sey dis rights no dey for we 1999 Constitution. As it be so, dem dey under Chapter 2 of the 1999 Constitution but we no fit enforce dem. Why? Because Section 6(6)(c) don mek that Chapter 2 wey dem put dis rights non-justiciable. Dis be sey Nigerian courts no fit adjudicate on mata wey concern dem. If pesin carry di mata go court, di Court go strike am out. My pipu, what we go take pen wey no get ink do. Abi, phone wey no get battery.
Options to Judicial Enforcements
Authors wey write on di enforcement of socio-economic rights don talk about the ways we fit enforce dem. First, we fit enforce am by using the fundamental human rights wey dey for Chapter 4 of di 1999 Constitution. For example, we enforce di right to good standard of living and good environment, wey be socio-economic rights, by using di right to dignity abi di right to life.
Secondly, we fit enforce am by using di provisions of already ratified international instruments like African Charter on Human and People’s Right before Nigerian Courts or regional courts. For example, we fit enforce di right to education under di provision of di African Charter on Human and People’s Rights. In Festus Odafe & Ors v Attorney General of the Federation and 3 others, Suit No.FHC/PH/CS/680/2003, di Federal High Court mandate di federal government by Article 16(2) of the African Charter on Human and People’s Rights mek dem provide medical care to four prisoners we dey HIV positive. In SERAP v Nigeria & Ors, SERAP wey be a civil society organisation carry the President of Naija and other pipu go ECOWAS Community Court and talk am sey dem violates some socio-economic rights like right to adequate standard of living, right to health, to food, to clean and healthy environment for certain part of Niger Delta. Dem con rely on African Charter on Human and People’s Rights, International Convenant on Civil and Political Rights and the International Convenants on Economic, Social and Cultural Rights. Di Court talk am sey him get jurisdiction to entertain di mata because Naija be member nation of Economic Community of West Africa State (ECOWAS).
Third, di federal government fit “give expression” to dis socio-economic rights wey dey under Chapter 2 pursuant to Item 60, Part 1 of the Second Schedule of the 1999 Constitution (exclusive legislative list). By “giving expression”, we mean sey dem go mek legislations we protect for dis rights. Dem don do dis for di enactment of di Compulsory Free Universal Basic Education Act (for free education) and the Corrupt Practices and Other Related Offences Act (to abolish corrupt practices and abuse of power puruant to Section 15). In Attorney-General of Ondo State v Attorney-General of the Federation, Uwais (CJN, as he was then) talk am sey di enactment of the Corrupt Practices and Other Related Offences Act which establishes di ICPC and give dem power to enforce section 15 (5) of the Constitution dey valid and to say him no dey na to leave the ICPC with no authority. However, government still dey avoid dem responsibilities under dis legislations by saying dat di different socio-economic rights which dem protect no dey justiciable under 1999 Constitution.
All these na solutions to di problem of enforcing dis socio-economic rights in Nigeria but my pipu, it no be The Solution. True sey Nigeria don ratify the African Charter on Human and People’s Right under section 12 of the 1999 Constitution. Di issue be sey sections wey pesin fit use enforce di right to education, for instance, dey contrary to di provisions of di Constitution we mek dem unenforceable. In essence, those sections for African Charter on Human and People’s Right dey inconsistent with the 1999 Constitution. The result be sey e go be void to the extent of its inconsistency. Section 1(2) of the 1999 Constitution talk am sey if any law dey inconsistent with di Constitution, di Constitution go prevail and dat law go be void to di extent of its inconsistency. Even with di international flavour wey African Charter on Human and People’s Right get, the court for Abacha and others v Fawehinmi talk am sey e no superior to the Constitution and National Assembly fit remove am from we body of laws by repealing Cap. 10
The Way Forward
Di sure bet to di enforcement of dis socio-economic rights be constitutional ammendment to make justiciable di provisions of Chapter 2 of the Constitution. In our present Nigeria wey majority know poverty, dey suffer from bad health system and poor standard of living, the justiciability of Chapter 2 dey very important. In fact, it no too much to say pikin wey still dey for dem mama’s bele know sey things hard for Naija. The justiciability of these socio-economic rights be a way of making we government sit up and accountable.
One concern be sey if dem make dis rights justiciable and enforceable, it fit open floodgate of cases against di government in di absence of adequate resources wey dem fit use cater for di growing population. On dis mata, the Constitutional Court for South Africa in Government of the Republic of South Africa v Grootboom use the concept of reasonableness and talk sey dem go see if the measures govament adopted dey reasonable to meet dem obligations. Aside di test of reasonableness, we also get di minimum core threshold wey we fit use determine whether the govament dey work to provide for dis rights. This be sey govament don make effort to use di available resources to satisfy dis minimum obligations on priority basis.
In all, constitutional ammendment to mek justiciable all di socio-economic rights wey dey for Chapter 2 of we 1999 Constitution go sweet. But in di absence of dis ammendment, as e be now, the Court still fit decide cases on dis mata if pesin institute am in one of di ways we don discuss above. Mek we just quickly put am down sey di absence of impediments in di enforcement of dis socio-economic rights na di beginning of we govament accountability and beta life for we pipu of Naija.
My pipu, no forget comment, like and share dis post.

